Cameroon vs Guinea highlights: Frank Magri equalise afta Mohamed Bayo score first for dia Afcon 2023

Wia dis foto come from, Getty Images 15 January 2024 Five-time champions Cameroon play draw wit Guinea wey play most of di game wit 10 men. Di early stages of di Africa Cup of Nations continue to produce surprise results.

15 January 2024

Five-time champions Cameroon play draw wit Guinea wey play most of di game wit 10 men.

Di early stages of di Africa Cup of Nations continue to produce surprise results.

Guinea, wey dey ranked 80th for di world, shock di stadium wen Mohamed Bayo score to give dem di early lead.

But dem get to play di entire second half a man short afta dia skippo Francois Kamano stamp on Frank Magri heel.

Na Magri wey nod in Georges-Kevin Nkoudou cross to equalise for Cameroon but Guinea work hard to collect a deserved point.

Di Indomitable Stars almost snatch victory towards di end but Guinea keeper Ibrahim Kone make fine save from Karl Toko Ekambi to make sure say dem collect sometin for di match.

Di draw mean say both sides get work to do to qualify for di knockout stages dis one wey di holders Senegal dey top of Group C afta dia comfortable 3-0 victory ova Di Gambia earlier on Monday.

Dis na also anoda surprise outcome for di tournament for Ivory Coast afta Ghana lose to Cape Verde on Sunday while Egypt and Nigeria play draw wit Mozambique and Equatorial Guinea.

Checkout di match highlights.

Second half

90+7 mins- Match don end

90+6 mins- Issiaga Sylla replace Mory Konate.

90+5 mins- Cameroon free kick, dey blocked by one of di defenders.

90+4 mins- Ilaix Moriba shot from distance but im no fit find di target.

90+2 mins- Georges-Kevin N'Koudou don commit foul during one attacking move and now di referee don blow im whistle.

90 mins- Di fourth official show 6 mins. of added time.

88mins- Ibrahim Kone makes good save to stop one great chance. Di ball falls to Karl Toko Ekambi wey dey inside di box im shot, but di ball end up for di keeper hand.

85 mins- Today match don ends for Olivier Kemen wey dey replaced by Faris Moumbagna).

85 mins- Mohamed Bayo don comot and Kaba Diawara bring in Jose Kante.

85 mins- Di ball rebounds out to Olivier Kemen for di edge of the box. Immediately im shot for goal, but di ball go high ova di bar.

84 mins- Jean-Charles Castelletto cross ball inside di box wey find Georges-Kevin N'Koudou, im control di ball well but one of di defenders intercept.

81 mins- Georges-Kevin N'Koudou take di corner for Cameroon but di defence clear am

77 mins- Jean-Charles Castelletto fine pass to Georges-Kevin N'Koudou, but im no fit connect.

75 mins- Frank Magri don comot for Junior Tchamadeu

75 mins- Substitution! Christopher Wooh don comot and Oumar Gonzalez don enta.

73 mins- Heat dey oh! di ref don signal for cooling break so di players fit drink water

70 mins- Corner to Cameroon

69 mins- Frank Magri cross ball inside di box but di defence clear di ball.

67 mins- Olivier Ntcham collect pass and decides to fire di ball from long range, but im shot go ova di bar.

63 mins- Mouctar Diakhaby need to dey very careful for di rest of di match aft aim collect yellow card from referee for bad tackle.

62 mins- Ilaix Moriba cross long ball from free kick but Fabrice Ondoa intercept am.

62 mins- Mutaz Ibrahim don give yellow card to Harold Moukoudi for foul.

61 mins- Julian Jeanvier fit don get minor injury, but e be like say im go fit continue to play.

60 mins- Jeanvier get small injury, di physio dey check am.

58 mins- Fine block from di defender e means say mean say Cameroon corner no worry Guinea.

56 mins- Morgan Guilavogui don comot for Facinet Conte

56 mins- Substitution. Antoine Conte don comot and Ibrahim Diakite don enta as substitute.

55 mins- Georges-Kevin N'Koudou (Cameroon) take di free kick from mid-range, but im balloon di ball high ova di bar.

55 mins- Cameroon win direct free kick for dangerous mid-range position.

54 mins- Julian Jeanvier bad tackle and npw Mutaz Ibrahim don blow for foul.

52 Mins- Mutaz Ibrahim don blow im whistle afta Antoine Conte bring down one of im opponents down wit strong tackle.

51 mins- 1 - 1

Goal! Frank Magri find space inside di penalty area and head di ball inside di net na sweet header!

49 mins- Frank Magri (Cameroon) swing in one cross, but one defending player clear di ball to safety.

46 mins- Mutaz Ibrahim blow im whistle and di second half start.

First half

45+7 min- Half time don reach referee don blow im whistle.

45+6 mins- Georges-Kevin N'Koudou crosses di ball, but Ibrahim Kone read am and catch di ball.

45+5 mins- Free kick to Cameroon out wide

45+3 mins- Francois Kamano don collect red card from referee Mutaz Ibrahim afta VAR review.

45+2 mins- Referee get signal for im ear im dey go check di foul earlier by Francois Kamano using VAR. Dis fit be red card!

45+1 mins- Francois Kamano don collect yellow card.

45 mins- 4 min. of stoppage-time n aim dem go play

43 mins- Georges-Kevin N'Koudou run into di box but im no fit work any space to shot. Di ball don go out of play for goal kick.

41 mins- Mouctar Diakhaby dey injured di referee don stops play so im fit receive medical treatment.

38 mins- Olivier Ntcham (collects pass and shot from distance but e dey blocked.

38 mins- Georges-Kevin N'Koudou play short pass to im teammate from di corner instead of crossing di ball inside di box.

38 mins- Georges-Kevin N'Koudou try to pass but e dey blocked

36 mins- Georges-Kevin N'Koudou try to find im teammates wit free kick inside di box, but di keeper react well.

35 mins- Mutaz Ibrahim blow im whistle afta Morgan Guilavogui kick im opponent legs instead of di ball.

33 mins-Harold Moukoudi pass ball inside di box, but di opponents clear di ball

31 mins- Di referee don blow for cooling break.

30 mins- long-range shot from Sekou Sylla. Unfortunately for him, im shot go just a few inches ova di bar.

29 mins- Darlin Yongwa don commit foul. Mutaz Ibrahim don stop di game. Guinea get free kick from long distance,.

28 mins- Karl Toko Ekambi dey offside, di linesman don raise im flag.

27 mins- Frank Magri from di side of di pitch fly inside di box, but nobody dey dia

26 mins- Cameroon dey enjoy possession, dem dey exchange passes dey wait for opportunity to strike.

24 mins- Karl Toko Ekambi try to hold on to collect di ball, but e too long. Di ball don go out of play and Guinea get goal kick.

21 mins- Frank Magri bring im opponent down and chop yellow card from di referee.

21 mins- Georges-Kevin N'Koudou send one long ball across di pitch, but e misses im target.

19 mins- free kick to Cameroon.

17 mins- Aguibou Camara dey call for medical attention. Di extent of im injury no dey clear.

13 mins- Frank Anguissa make fine run to reach di ball but im header go wide.

13 mins- Cameroon get free kick from mid-range.

10 mins- 0 - 1

GOAL! Lovely finish directed inside di back of di net by Mohamed Bayo .

8 mins- Jean-Charles Castelletto fine cross inside dibox, but e dey too close to Ibrahim Kone,

7 mins- Guinea get free kick near di side line.

6 mins- Darlin Yongwa bring down im opponent. Mutaz Ibrahim di referee don blow im whistle for foul.

5 mins- Cameroon get free kick afta Antoine Conte commit foul.

4 mins- Sekou Sylla chop foul. Referee don blow im whistle.

3 mins- Aguibou Camara go on solo run, but im no fit create any chance as di opposition player block am.

1 min – Match don start

Cameroon lineup

Starting XI: Ondoa, Castelletto, Wooh, Moukoudi, Yongwa, Ntcham, Kemen, Zambo, Magri, Toko Ekambi, Nkoudou

Subs: Ngamaleu, Tolo, N'Jie, Ateba, Tchamadeu, Gonzalez, Epassy, Neyou, Moumbagna, Elliott, Ngapandouetnbu, Tchato

Guinea lineup

Starting XI: Kone, Antoine Conte, Jeanvier, Diakhaby, Sekou Sylla, Moriba, Konate, Guilavogui, Aguibou Camara, Kamano, Bayo

Subs: Aly Keita, Issiaga Sylla, Sow, Naby Keita, Diakite, Mohamed Camara, Karim Cisse, Seydouba Cisse, Moussa Camara, Kante, Facinet Conte

Match facts

Five time champions Cameroon go face Guinea on Monday evening for dia first group match for di African cup of Nations.

Dis na dia 21st appearance for Afcon, na only Egypt wit (26), Côte d’Ivoire wit (25) and Ghana wit (24) don show face pass dem for di tournament.

Egypt wit dia (7) titles na di only team wey go win di tournament on more occasions pass di Indomitable Lions wey get (5).

Na Cameroon bin win di previous Afcon wey bin shele for Côte d’Ivoire, for 1984. Dem beat Nigeria 3-1 for di final.

Meanwhile Guinea dey take take part for dia 14th CAF Africa Cup of Nations.

Dis na highest number of appearances for a team for di tournament witout winning di title – di closest dem bin go na for 1976 wia Guinea finish second to Morocco for den wetin bin be di final group stage.

Guinea don reach di knockout stages of dis competition for six of dia last seven participations but dem neva pass di knockout phase of di competition during dat time, either for normal/extra-time or on penalties.

Di West African team don win only two of dia last 13 matches of CAF Africa Cup of Nations (D6 L5), dia 2-0 win against Burundi for 2019 and 1-0 against Malawi for 2022.

Dis game go be di third time wey Cameroon go jam Guinea for CAF Africa Cup of Nations, all dia matches take place for di group stages.

Di two previous meetings end for draws: 2-2 for 1998 and 1-1 for 2015.

Vincent Aboubakar and Karl Toko Ekambi score 13 of Cameroon 14 goals for di 2021 CAF Africa Cup of Nations, eight and five respectively.

Aboubakar total na di highest for an edition for di tournament since 1974.

Cameroon Rigobert Song dey make im first CAF Africa Cup of Nations appearance as head coach.

As a player, im play for a joint-record eight Afcon tournaments and win on two occasions (2000, 2002).

Guinea nine goals wey dem score for di qualifiers of di African Cup of Nations na eight different players score for dem, Naby Keïta na di only player to score twice.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmmqqknrCtsdJomrBxYK9%2Fr4DDs2yo

 Share!